20 December 2023
Three of di world biggest pornography sites go face stricter regulation for di European Union.
Dem go legally make am compulsory for Pornhub, Xvideos and Stripchat to improve content moderation and toughen up age verification for users.
Dis na because dem see say di sites get at least 45 million monthly users for EU kontris.
E mean say dem don label dis porn sites as Very Large Online Platforms (VLOPs) under di EU Digital Services Act (DSA).
EU Digital Commissioner Margrethe Vestager tok say dis go "allow for higher scrutiny and accountability of dia algorithms and processes".
"I dey very clear say creating a safer online environment for our children na enforcement priority under di DSA," she add.
Di BBC don approach Pornhub, Xvideos and Stripchat for comment.
Wetin be di new rules
Di porn sites get four months to ensure say dem meet series of legal requirements wey include:
- Putting in place extra measures to fight di spread of illegal content, like child sexual abuse material and deepfake pornography
- Adding stronger protections against children accessing dia sites, including with age verification tools
- Ensure say dia risk assessments plus dia compliance wit all di DSA obligations dey externally and independently audited
- Dem dey subject to increased transparency, wit di obligation to provide access to dia data to researchers wey di EU approve
- Platforms must agree to quickly remove any illicit content as soon as dem dey aware of am, dem must also inform legal authorities if dem spot serious criminal offences for di content submitted online
- Dem forbid dem from exploiting sensitive user data like political leanings, religious faith.
Di EU Commission go dey responsible for ensuring say di sites meet di new, more stringent rules.
Dem fit dey fined up to 6% of dia global turnover if dem fail to do so.
Dis companies na di second batch of firms to dey designated VLOPs.
For April, dem tell 19 tech giants - including Facebook, Google and YouTube – say dis new rules apply to dem too.
For dat initial round of companies, di DSA bin come effect for August.
Dem tell one of dem, X (former Twitter) on Monday say di EU dey suspect am of breaking dia obligation under di DSA to combat disinformation – di first enforcement proceedings dem go launch under di legislation.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomm2mqa2Gc32VoKeo